By: Yusuf Abuh
Lagos State Gornment don beg residents make dem calm down after heavy rain cause ogbonge flooding for many parts of di state in di last two weeks.
Gofnor Babajide Sanwo-Olu like dis don approve immediate cleaning for 28 water channels to help reduce flooding.
Oga Commissioner of Environment, Tokunbo Wahab naim explain dis mata give tori pipo o Tuesday, say na heavy rain wey fall for places like Victoria Island, Lekki, Ikeja, Gbagada, Mushin and Mafoluku.
E add say flooding no be only Lagos problem, as other African countries and some cities for North America also experience di same heavy rainfall, an dat gorment dey try manage am.