By: Yusuf Abuh
France pull weight for World Cup as dem beat Sweden 3-0 on Tuesday to enter tdi round of 16 match where dem go face Paraguay.
Kylian Mbappe score two goals inside di heavy match inside MetLife Stadium for New Jersey, and di first goal enter small time before half-time after France hit post two times.
Michael Olise ball wetin nor good, for di match as na im give Bradley Barcola di correct pass to score the second goal for 53 minutes.
To complete di clean win, di same Olise provide another sweet pass for Mbappe to logic di third goal inside di match wey France dominate from start to finish.