By : Jolayemi Olajide
Di Federal Gornment don tuk am again say dem dey ready to wire security for Niger Delta so that Nigeria fit start to drill more crude oil.
Di Minister of Defence, Christopher Musa, tuk dis one after one closed-door meeting with big stakeholders inside di oil and gas sector for Port Harcourt Barracks, Rivers State.
Musa tell journalists say things like sea piracy and armed robbery don really go down for di region, but di Armed Forces still dey work tight to ensure everywhere dey double safe.
He con add join say even though security don try small, things still fit beta pass like dis as dem dey look for final solution to di wahala wey dey face di oil industry.