Konfam 89.5 FM News

6 Results / Page 1 of 1

Background

Economics

FG Promise To Tighten Security For Niger Delta To Push Oil Production Up

By : Jolayemi Olajide Di Federal Gornment don tuk am again say dem dey ready to wire security for Niger Delta so that Nigeria fit start to drill more crude oil. Di Minister of Defence, Christopher Musa, tuk dis one after one closed-door meeting with big stakeholders inside di oil and gas sector for Port Harcourt Barracks, Rivers State. Musa tell journalists say things like sea piracy and armed robbery […]

todayJuly 1, 2026 12

OBODO NAIJA

NDC  Upload Peter Obi Name As Dia Presidential Candidate for 2027

By : Jolayemi Olajide Unto election 2027 waka, say di breeze don blow reach di Nigeria Democratic Congress (NDC),  like dis,  dem  don successfully upload di papers of dia presidential candidate,  Peter Obi, enter di INEC portal. Di National Leader of di party, Sen. Seriake Dickson, break di news for im 'X' handle and explain say everything dey waka uniform with di INEC timetable. Dickson tuk say di name of […]

todayJuly 1, 2026 8

obodo oyinbo

Cholera Kpai 120 pipo for Sudan

By : Jolayemi Olajide Nor be small tin say one wicked  cholera outbreak don scarra  Sudan,   kpai  120 pipo, and dem sti dey suspect  1,102  cases. The World Health Organization (WHO) tuk say di three years war between the Sudan army and the RSF fighter group don scatter the country healthcare system kpata-kpata. Dis na di third time wey cholera heavy wave dey hit Sudan back-to-back inside three years, just […]

todayJuly 1, 2026 16

Lagos

Lagos Gornment Blame Blocked Gutter for Flood Wahala

By : Jolayemi Olajide Lagos State Gornment don drop micro soft word say flood na normal thing, but dem dey work to reduce the effect through beta drainage system. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, yarn dis one for tv sit down tuk on Wednesday, say no gornment fit stop rain or flood completely, but dem go try. According to am, wetin gornment fit do na to reduce […]

todayJuly 1, 2026 13

Obodo Niger

US Supreme Court knock Trump, rule say birthright citizenship must stay

By : Jolayemi Olajide Omo blow, blow don burst, dat  United States Supreme Court don block Presido, Donald Trump order wey bin wan end birthright citizenship for US soil. This judgment na big slap for Trump face as e dey try change  immigration law for  America. U sabi say, When Trump enter office on January 20, 2025, E sign one executive order, say if any parent go born for America […]

todayJune 30, 2026 14

Sport Yarns

Canada, Paraguay, Morocco and Brazil  qualify for Round of 16, 2026 world cup

By : Jolayemi Olajide Chale, like dis, four  teams don enter the Round of 16 for the 2026 FIFA World Cup after dem win dia opening Round of 32 matches. As at Tuesday morning, Canada, Paraguay, Morocco, and Brazil don match forward to di round of 16 Canada naim  first move on Sunday after dem beat South Africa 1-0, before Paraguay and Morocco use penalty shootout arrange dia ticket on […]

todayJune 30, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds