By: Yusuf Abuh
Wi oga Presido, Bola Tinubu don order wi Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCCPC) dat make dem touchlight all di big technology companies and AI to ensure say dem nor spoil business for Nigerians.
Di order dey come after the Nigerian Press Organisation (NPO), number one joinbodi tatafos, wire message to wi baba seyi say tech companies wan comot food for dia table.
According to statement wey FCCPC release on Monday, Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, na im deliver the Federal Government directive to di commission.
FCCPC go touch light companies like Meta, Alphabet, X and some AI platforms to find out whether whether true true dem wan comot food for Nigeria tatafos table.