Local

Delta Commissioner of Police Punish Two Police Officers

todayJuly 7, 2026 7

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Two police officers don chop beta koboko for Delta State, don lose dia rank after dem find dem guilty of extortion and other misconduct ontop one viral video.

For di viral video di police dey collect kpaje with POS from motorist through POS
Delta Police tuk, tuk, SP Bright Edafe, konfam dis development say Commissioner of Police, CP Yemi Oyeniyi, approve di punishment after orderly room trial.

Di officers, Inspector Augustine Jeremiah and Corporal Miracle Ehirim of C Division, Asaba, bin appear for di viral video wey surface for January 13, 2026.

Police say dem break di law with disobedience to lawful order, extortion and disgraceful conduct under di Police Act 2020, na why dem reduce dia rank.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds