By: Yusuf Abuh
Wi Minister of Works, Dave Umahi, don spill out new plans to stop Lagos flooding for di Lagos-Calabar Coastal Highway, say dem one build new gutters.
Umahi tuk dis one meeting with stakeholders for Lagos say, dem joinbodi with di lagos gornment build service lanes.
He explain say dis new plan na long-term arrangement to put end to di flood problem wey heavy rainfall dey always cause for di area.
But di koko be say, di minister drop warning dat dis project go touch some people, as dem go scata properties within 15 meters to di highway to make space for di new road and gutters.