Lagos-Calabar Coastal Highway

5 Results / Page 1 of 1

Background

OBODO NAIJA

Lagos-Calabar Coastal Highway Na Di Best Gift To Nigerians

Minister of Works, Dave Umahi, don describe Lagos-Calabar Coastal Highway as di best gift Presido Bola Tinubu administration don give Nigerians. E make di statement on Monday for flag-off of di dualisation of Ibadan-Ijebu-Ode road along Idi Ayunre axis for Ibadan. Umahi tok say pipo for Lagos don dey feel di benefit of di road as journey from Epe to Lagos wey dey take seven to eight hours before, now […]

todayAugust 25, 2026 15

Lagos

Thieves Don Meet Dia Match! FG Deploy Coastal Guards To Protect Lagos-Calabar Highway

By: Yusuf Abuh Federal Gornment don deploy 40 Coastal Guards to protect di Lagos-Calabar Coastal Highway from vandals, as Federal Controller of Works Olufemi Dare launch di security team for Lagos on Thursday. Olufemi Dare tok say di move become necessary because criminals dey steal manhole covers and vandalise road facilities along di highway. Di Federal Gornment equip di guards with tracked bikes and other patrol equipment to help dem […]

todayJuly 24, 2026 15

OBODO NAIJA

Federal Gornment Do Naming Ceremony For Lagos-Calabar Highway, Say Na Bola Ahmed Tinubu Coastal Highway

By: Yusuf Abuh Wi Federal Gornment don rename the Lagos-Calabar Coastal Highway as "President Bola Ahmed Tinubu Coastal Highway" to honor di presido for di project. Di Minister of Works, David Umahi, announce dis change on Thursday inside Abuja during media briefing. Umahi explain say di Ministry of Works take dis decision because of di long-standing vision wey oga Presido get to build di massive road project for di country. […]

todayJuly 17, 2026 9

Lagos

Federal Gornment To Scatta Tins To Build Gutters For Lagos Coastal Highway

By: Yusuf Abuh Wi Minister of Works, Dave Umahi, don spill out new plans to stop Lagos flooding for di Lagos-Calabar Coastal Highway, say dem one build new gutters. Umahi tuk dis one meeting with stakeholders for Lagos say,  dem joinbodi with di lagos gornment build service lanes. He explain say dis new plan na long-term arrangement to put end to di flood problem wey heavy rainfall dey always cause […]

todayJuly 8, 2026 12 1

Lagos

Lagos-Calabar Coastal Road Don Open Small To Ease Lekki Traffic

Di Federal Government don give green light make dem open di Lagos-Calabar Coastal Highway small time after one truck accident wey happen for Chisco area, Lekki on Monday scatter traffic for di whole area. Dis one dey inside statement wey di Lagos State Ministry of Transportation drop, wey talk say di Federal Ministry of Works don approve make motorists use di road until dem clear di wahala for di main […]

todayNovember 3, 2025 33

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds