OBODO NAIJA

Three Kpai as Heavy Windstorm Scatter Houses for Yobe

todayJuly 9, 2026 6

Background
share close

One strong windstorm wey blow for Wednesday evening don kpai three pipo and wunjure several others for Gashua, headquarters of Bade Local Government Area for Yobe State.

Di Chairman of di LGA, Ibrahim Babagana, tell media tuktuk pipo say di windstorm last for just 30 minutes and e fit confirm say three pipo don kpai.

E describe di incident as one of di worst windstorms wey e don ever see, saying Gashua never experience this kind disaster for many decades.

Di council chairman don submit report give di State Emergency Management Agency (SEMA), urging di agency to quickly send relief materials because di disaster pass di capacity of di local government.

Gashua also dey face flooding palava sake of say di town dey close to Yobe-Kumodugu River.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds