By Esther Daniel
Oga Chairmo for wi number one election body, INEC, Prof. Joash Amupitan, SAN, don don bring neck comot say make federal gorment increase dia money for 2027 election.
Prof. Amupitan tuk dis one during one courtesy visit to Chairmo of wi gorment house pipo wey dey hand money, Dr. Mohammed Bello Shehu, for Abuja.
Im say di visit na to strengthen beta working relationship between the two gornment agencies.
INEC Chairman also explain say things price don go up and dat, dem need dis increase to do beta welfare for dia workers.