OBODO NAIJA

INEC Back David Mark ADC Leadership, Reject Rival Group for 2027

todayJuly 15, 2026 6

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Independent National Electoral Commission, INEC, don fry mouth clear di air say na only African Democratic Congress, ADC, leadership wey Senator David Mark dey lead dem go recognise to submit candidates for 2027 general election across Nigeria.

INEC National Commissioner, Mohammed Haruna, naim go tuk for interview dat dem don give Mark-led leadership access to the nomination portal.

Haruna explain say rival faction no get legal right to submit any candidate because court no recognise dem and dem lose their appeal for recognition.

Following the clarification, ADC welcome INEC decision and call on security agencies make dem investigate and prosecute factional leader, Nafiu Gombe, over wetin party describe as false claim say e use INEC portal upload candidates.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds