2027 ELECTIONS

9 Results / Page 1 of 1

Background

OBODO NAIJA

2027 Fit Enter Trouble! INEC Chairman Demand Financial Freedom For Electoral Body

By: Yusuf Abuh INEC Chairman, Prof. Joash Amupitan, don warn say free, fair and credible 2027 elections fit dey difficult unless di electoral body get full financial autonomy, as e tok during one book launch for Shehu Musa Yar'Adua Centre, Abuja, say, "If we are serious about strengthening our institutions and conducting free, fair and credible elections, then financial autonomy is essential." Amupitan explain say although di Constitution place INEC […]

todayJuly 24, 2026 14

Entertainment

Falz clear air say e never support any politician 

By : Jolayemi Olajide Nigerian rapper Falz don clear di air on Tuesday say e never openly support Peter Obi or any politician, as e yarn for siddun tuk. Falz say people get am wrong because all along na to encourage Nigerians, especially youths, make dem come out vote naim e dey do. Di singer explain say e believe for free and fair elections and no wan tie himself to […]

todayJuly 22, 2026 9

Politics

Appeal Court Give INEC Green Light To Continue 2027 Election Plans

By : Jolayemi Olajide Appeal Court for Abuja on Thursday cancel di earlier court judgment wey stop INEC election timetable for 2027, saying di commission get right to fix dia election plans. Di judges agree say INEC do di correct thing when e release di timetable, and say di earlier court no follow di law well. Di court also tok say all di dates wey INEC fix for di 2027 […]

todayJuly 16, 2026 11

OBODO NAIJA

INEC Back David Mark ADC Leadership, Reject Rival Group for 2027

By : Jolayemi Olajide Independent National Electoral Commission, INEC, don fry mouth clear di air say na only African Democratic Congress, ADC, leadership wey Senator David Mark dey lead dem go recognise to submit candidates for 2027 general election across Nigeria. INEC National Commissioner, Mohammed Haruna, naim go tuk for interview dat dem don give Mark-led leadership access to the nomination portal. Haruna explain say rival faction no get legal […]

todayJuly 15, 2026 10

National

INEC Shift Deadline for Presidential, NASS Candidate List

By Ebi Oboko Independent National Electoral Commission (INEC) don extend di deadline for political parties to submit names and credentials of candidates wey go contest 2027 presidential and National Assembly elections. Di electoral body say parties now get until midnight on Tuesday, July 14, instead of di earlier Saturday, July 11 deadline. According to INEC, di extension follow appeals from some political parties wey complain say dem face challenges to […]

todayJuly 12, 2026 17 16

Politics

EFCC Oga explain how Politicians take dey Chop Gorment money

By : Shalom Ovie EFCC Chairmo, Ola Olukoyede, don open secrete tuk why public money dey lost, say na based on di fact politicians dey spend too much for election. Naim make once dem enter office, dem go begin gather money wey dem spend for election and con take extra. E tuk dis one on Wednesday for one lecture for University of Ilorin about peaceful and credible 2027 elections. However […]

todayJune 11, 2026 13

National

Taraba Governor Go Meet Tinubu For Aso Rock

Taraba Governor Agbu Kefas don go Aso Rock to meet Tinubu for closed-door session, E waka enter inside di Presidential Villa around 2pm on Monday. Dis na im first visit since e dash PDP goodbye join APC, and e waka enter di State House with APC National Chairman, Prof. Nentawe Yilwatda. Kefas cancel im APC welcome wey suppose hold November 19, say e no make sense to celebrate while Kebbi […]

todayDecember 1, 2025 24

National

2027: Osun, Lagos, Ogun Lead as INEC Register Over 3.5 Million PVC [Full List]

More than 3.5 million Nigerians don pre-register online for their Independent National Electoral Commission (INEC) Permanent Voters Cards (PVC) as dem dey prepare for 2027 general elections. INEC announce this news on Monday, just two weeks after the registration exercise begin. According to the data wey dem release, Osun state dey lead with 518,635 registrations, followed by Lagos State wey get 440,647 and Ogun State wey get 348,217 registrations so […]

todaySeptember 9, 2025 35

Politics

2027: APC Open Door Make Anybody wey Get Liver Contest Against Tinubu

The All Progressives Congress (APC) don talk say even though plenty people don endorse President Bola Tinubu for second term, other people wey dey inside di party and wan contest for president in 2027 still fit try their luck. APC National Organising Secretary, Sulaiman Argungu, talk dis one on Wednesday for one news session with journalists for party headquarters for Abuja. He talk say di party leadership including di National […]

todayAugust 28, 2025 39

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds