By: Esther Daniel
Di Central Bank of Nigeria (CBN) don confirm say e open two foreign currency account for presidential foreign investment promotion council(PFIPC)
Di confirmation come on Monday during House of Representatives public hearing for Abuja.
CBN tuk say dem open di accounts after dem receive instruction from di Office of di Accountant-General of di Federation.
Meanwhile, Oga Tinubu Chief of Staff, Femi Gbajabiamila, appear before ICPC to give statement as investigation into di alleged fake agency dey continue.
Di hearing also show say na way to dodge law for government process allow di agency operate like official government body.