Lagos

Lagos Taskforce Gbab 33 Suspects, Recover Drugs And Dangerous Weapons

todayJuly 28, 2026 10

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Lagos State Environmental and Special Offences (Enforcement) Unit don go kramp 33 suspected jaguda criminals on Monday for different areas of Lagos Island and Lekki corridor.

Di Agency tuk tuk person, Raheem Gbedeyan, naim sorosoke dis mata, say di pipo wey dem gbab include area boys, pipo wey dey sell  drugs, drug addicts, illegal okada riders, ticket touts and other jadugas, while officers recover Tramadol, Indian hemp, Colorado, marijuana, cannabis, cutlasses and scissors.

Gbedeyan explain say di operation na part of Lagos State effort to tackle environmental offences, drug abuse and criminal activities across di affected communities.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds