south west

Three kpai As Two-Storey Building Collapse For Ogun

todayJuly 28, 2026 6

Background
share close

By: Esther Daniel

At least three pipo naim dem don konfam say kpai after one two-storey building collapse gbuaii for ground inside Baale Road, Ajuwon area of Ifo Local Gornment Area for Ogun State.

South-West Zonal Director of NEMA, Saheed Akiode, naim use im yamchop mouth dey konfamate dis badness say dam sha rescue 12 pipo alive from di rubble.

Akiode say dem go bring down di remaining part of di building completely so emergency workers fit access everywia under di collapsed structure.

He add say NEMA don activate all emergency agencies since Monday, as he call on residents to remain calm while rescue and recovery operations continue.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds