BUILDING COLLAPSE

10 Results / Page 1 of 2

Background

south west

Three kpai As Two-Storey Building Collapse For Ogun

By: Esther Daniel At least three pipo naim dem don konfam say kpai after one two-storey building collapse gbuaii for ground inside Baale Road, Ajuwon area of Ifo Local Gornment Area for Ogun State. South-West Zonal Director of NEMA, Saheed Akiode, naim use im yamchop mouth dey konfamate dis badness say dam sha rescue 12 pipo alive from di rubble. Akiode say dem go bring down di remaining part of […]

todayJuly 28, 2026 11

OBODO NAIJA

Four Still Dey Trapped, Three Escape As Building Collapse For Kano

One two-storey building wey dem still dey build for Sultan Road, Nasarawa Local Government Area of Kano State, don collapse, trap four people. Di incident happen around 9 a.m. on Friday, July 10, 2026. According to eyewitnesses, di construction workers notice say di building wan collapse while dem dey work for di top floor, dem quickly run comot to save dia lives. But four people, including one security guard and […]

todayJuly 10, 2026 32

Lagos

LASEMA Yarn Say No Building Collapse For Alakija

Di Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) don officially clear bad air wey dey spread for social media say one building collapse for Alakija area. LASEMA Permanent Secretary, Dr. Olufemi Oke-Osanyintolu, konfamate dis for statement on Thursday say di report na lie and e dey mislead di public. Officials wey dem send to check di area after di news show face no find any evidence of any building collapse for […]

todayJuly 2, 2026 7

OBODO NAIJA

Two Pipo Kpai as Building Collapse for Port Harcourt

Residents for Odili Road, Port Harcourt, Rivers State, nor be small tin hapun yesterday, dem enter panic after one three-storey building collapse and trap some people under di rubble. Acting Permanent Seco for Rivers State Ministry of Health, Dr. Vincent Wachukwu, tok say emergency responders, ambulances and medical personnel quickly move go di scene after dem hear about di incident. E still konfam say two people wey get serious injuries […]

todayJune 25, 2026 15

Local

Building Collapse For Port Harcourt, Two Pipo Kpai

By: Yusuf Abuh Residents for Odili Road, Port Harcourt, Rivers State, enta panic on Wednesday afta one three-storey building collapse and trap some people under di rubble. Acting Permanent Secretary for Rivers State Ministry of Health, Dr. Vincent Wachukwu, tok say emergency responders, ambulances and medical personnel quickly move go di scene afta dem hear about di incident. E still konfam say two people wey get serious injuries don rescue […]

todayJune 25, 2026 10

Local

Construction workers trap inside Anambra three-storey building wey collapse

One three-storey building wey still dey under construction don collapse for Okpuno, Awka, Anambra State capital, near the Anambra State House of Assembly, off Ekwueme Square, around 11:40am on Thursday. The building wey get four suspended floors still dey for roofing stage when e suddenly fall, scatter everywhere, and throw people for the area into panic. People wey see as e happen talk say the building no give any sign […]

todaySeptember 26, 2025 34

Lagos

Fresh Scare For Lagos As Two-Storey Building Collapse On Top Residents

Six people, including one wey dey under debris, dem say dem rescue dem on Wednesday evening after one two-storey building collapse for Modupeola Street, Mangoro, for inside Alimosho Local Government Area of Lagos State. Naija News understand say di gbege wey happen around 6 p.m. na just two weeks after four people kpai for Ebute Meta when one three-storey building fall yakata. Lagos State Commissioner for Information and Strategy, Gbenga […]

todaySeptember 25, 2025 52 1

Lagos

Four People Don Die, Dem Rescue Six From Lagos Building Wey Collapse

Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) don confirm say dem rescue six people but four people die after one three-storey building collapse. Di building dey for No. 325, Bornu Street, Ebute Meta, Lagos State. For di place wey the gbege happen, LASEMA Director of Operations, Mr Olatunde Akinsanya, tell newsmen say dem receive distress call for 6:00 p.m. on Friday and dem quick send team go the scene. “To manage […]

todaySeptember 16, 2025 33

Local

Substandard Materials Blamed for the Latest Building Collapse for Lagos

Three people don die after one building collapse for Borno Way, Alagomeji, Yaba, Lagos State, and this na the second time such thing happen for the area in three years. The building wey collapse na at 333 Borno Way, where dem recover three bodies and rescue four people alive from the rubble. For November 16, 2023, one-storey building for 34 Oloto Street, Borno Way, off Freeman Street, Oyingbo, collapse too, […]

todaySeptember 15, 2025 71

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds