OBODO NAIJA

Nigeria Tell South Africa Make Dem Stop Xenophobic Attacks

todayJuly 29, 2026 5

Background
share close

Nigeria don call on South Africa to take urgent action to stop di repeated xenophobic attacks against Nigerians and other African nationals.

Minister of State for Foreign Affairs, Sola Enikanolaiye, tuk dis one during a meeting with South Africa’s Minister of International Relations and Cooperation, Ronald Lamola, for Abuja.

Enikanolaiye say President Bola Tinubu direct di meeting because di attacks dey threaten di long-standing relationship between both countries.

He also remind South Africa of Nigeria’s role in di fight against apartheid and express concern over di repeated attacks wey don hapun from 1995 reach 2026.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds