OBODO NAIJA

Heavy Flood Don Swallow Delta High Court, Houses and Shops for Agbarho

todayJuly 31, 2026 6

Background
share close

By: Esther Daniel

Heavy flood on Friday morning don cover Delta State High Court, houses and business places for Agbarho community in Ughelli North Local Gornment Area after overnight heavy rain from Thursday night .

Residents say communities like Orhokpokpor, Ehwere, Ughrwughelli and Oviri suffer serious damage as flood destroy furniture, electrical appliances, food items, clothes and other valuables inside many homes.

Shop owners suspend business while motorists and pedestrians struggle to pass flooded roads on Friday because di heavy rain disturb economic activities and movement across Agbarho.

Residents say na lack of proper drainage and blocked waterways dey cause di flood wey dey happen every time, add say anytime heavy rain fall, di damage and suffering for di area dey worse.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds