By: Yusuf Abuh
Suspected cult boys don kpai one security guard allegedly wey dem identify as Godwin for Abule Ijesha area of Yaba, Lagos, and dis one sef sup on Saturday.
According to eye witness di attackers come with motor, meet am near where e dey work, shoot am for head and later use axe attack am.
And dis one cause serious serious panic for di community.
However, as at di time wi package dis report police authority never konfam dis report.