By: Yusuf Abuh
Social Democratic Party presidential candidate, Adewole Adebayo, don tok say wi oga Presido, Bola Tinubu don already defeat himself ahead of the 2027 general election.
Im yarn dis one TV sit down tuk say di gornment never solve poverty, insecurity and other governance problems, and say na why many Nigerians dey disappointed.
E come advise Nigerians make dem face issues wey concern di country instead of putting all dia attention on politicians.