Lagos

Lagos Police Bust Fake Drug Warehouse

todayAugust 4, 2026 5

Background
share close

Lagos State Police Command say dem don bust two warehouses  wia pipo dey repackage fake drugs, and arrest two suspects.

Police Commissioner Fatai Tijani naim package dis mata one on Monday during press tuk, tuk doings inside Violent Crime Response Unit, Ijora Olopa, Lagos.

Di two suspects, Eze Okwudilichukwu, 52, and Chukwudi Mba, 42, naim dem catch dem for one warehouse along Otto Causeway, Otto, Lagos, where police say dem dey package suspected fake pharmaceutical products for distribution.

CP Tijani say di operation na part of police effort to stop fake drugs business and protect Nigerians from dangerous medicines wey fit cause serious health problems.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds