By: Esther Daniel
Sunday fun turn nightmare as drone strike hit Arkhipo-Osipovka beach for Krasnodar, Russia, kill seven people including three pikin and throw di area into panic.
Gofnor Veniamin Kondratyev accuse Ukraine of targeting civilians, say 40 people wunjor and 17 pipo still dey hospital for treatment.
People wey witness di attack tok say dem hear gunfire before one heavy blast as Russian air defence try stop di drone but e still crash for di crowded beach.
Ukraine never react to di allegation, while tourists complain say no emergency siren or warning come before di deadly drone strike happen