OBODO NAIJA

Wike Say Fubara Miss Second Term Chance Over Rivers Crisis

todayAugust 4, 2026 1

Background
share close

By: Esther Daniel

FCT Minister Nyesom Wike talk on Tuesday say di political crisis for Rivers State don cost Gornor Siminalayi Fubara im chance to contest for second term.

Wike yarn during im monthly media chat say wrong advice from political allies and outside interests make Fubara abandon di political structure wey bring am to power.

Di former Rivers governor reveal say e warn Fubara several times make e no derail, use im own experience as gofnor to advise am.

Wike insist say if Fubara stick with di political structure wey support am, di Rivers political crisis no for reach dis level.

 

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds