By: Yusuf Abuh
Russia embassy for Colombia don deny allegation say e get hand for network wey dey recruit Colombian mercenaries to fight for Ukraine war.
Di embassy tok dis one on Wednesday after Colombian news outlet Noticias Caracol publish investigation on Monday wey claim say Moscow dey use Colombians support dia war against Kyiv.
According to di embassy, dem no get any connection with di recruiters wey di report mention and dem no even know how dem dey fund dia activities.
Di denial come as di report continue stir fresh controversy over alleged recruitment of foreign fighters to join Russia war effort against Ukraine.