Nigerian Army Colonel Mohammed Ma’aji, wey dem accuse say naim plan dat wicked move to comot wi oga Presido Bola Tinubu from seat, don rake, wetin give am mind, noobodi sabi, but im say na patriotism and frustration, say wey hunger wire am ehn, nor be clear eyes im take plan corp.
Ma’aji yarn dis wan for one fresh court papers, di seniorman explain say hunger, hardship naim make im and im mehn run di mata, dat, as pipo dey suffer, e dey do dem like say Naija wan sink.
Investigators say di group allegedly develop di plan, suspend am and later revive am as dem continue to work on how to remove di gornment.
Cue like dis now di mata dey court.