Sports

PSG Coachie Luis Enrique Rake Say na Title Dem Dey go For

todayAugust 12, 2026 8

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Nor be small tin oh, Paris Saint-Germain coachie Luis Enrique say di European champions sti dey hungry oh to win everything dis season, as dem prepare face Aston Villa for UEFA Super Cup final on Wednesday.

PSG carry dia second straight Champions League title last season, alongside dia fifth consecutive Ligue 1 crown and oda trophies.

Luis Enrique team go open dia new season for Salzburg against Europa League winners Aston Villa with di Super Cup as dia first chance to win trophy.

Di Spanish coach say PSG must show dia true level on di pitch if dem wan continue dia winning ways.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds