OBODO NAIJA

FG To Deploy 300 NYSC Members As Certified CNG Technicians

todayAugust 12, 2026 4

Background
share close

By: Kofoworola Olayinka

Federal Gornment say 300 NYSC members go work for different CNG conversion centres across di obodo Nigeria after dem complete training and certification as CNG technicians.

Presidential aide Dr. Titilope Gbadamosi disclose dis on Wednesday for di opening of CNG Retrofitting Training Programme for corps members at NYSC FCT Orientation Camp, Kubwa, Abuja.

Gbadamosi say di programme go take place across all six geopolitical zones, as gornment dey train di youths dem to support Nigeria transition from petrol to compressed natural gas.

Di programme form part of Federal Gornment efforts to put Nigerian youths at di centre of di CNG transition and create more technical opportunities for corps members dem.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds