OBODO NAIJA

FG Warn Nigerians Make Dem Stop Steal Road Materials

todayAugust 13, 2026 6

Background
share close

By: Olabisi Olatunji

Federal Gornment don warn Nigerians make dem stop vandalising and carrying construction materials from Lagos-Calabar Coastal Highway.

FG media aide, Francis Nwaze, give di warning on Thursday, August 13, 2026, after pictures show some people allegedly dey carry materials from di road project.

Nwaze say anybody wey dey vandalise di highway dey attack national property and money wey belong to Nigerians.

Di warning come few days after Works Minister, David Umahi, launch Coastal Highway Guards for Lagos to protect di project and other important infrastructure.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds