OBODO NAIJA

High Court Give NDLEA Gbas Gbos, Make Dem Free KC Luxury

todayAugust 28, 2026 8

Background
share close

By: Mariam Ajayi

Lagos Federal High Court Judge, Justice Friday Ogazi, just give NDLEA hot query make dem carry body bring social media big boy KC Luxury, come face court after dem suuk am for cell for 14 solid days like garri inside water without even charging am to any crime.

AS KC Luxury lawyer wire the court ex parte motion, na so Baba Judge,  come tell the drug officers make dem use five days explain why dem hold person pikin tight like village masquerade secret.

According by  Afolabi  papa, na August 13 security operatives block KC luxury  for Murtala Muhammed Airport as hin dey form fine boy  wan fly go Paris, but since that day, nobody tell am weda na crime or na jazz e do.

Hin say Dis one na pure  oppression and dat e nor go gree.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds