OBODO NAIJA

Atiku Tell Tinubu: Your Time Don Reach, Prepare Handover

todayAugust 28, 2026 7

Background
share close

By: Kofoworola Olayinka

ADC presidential candidate, Atiku Abubakar, don knock Presido Tinubu gornment over promise to reduce transport fares, saying di policy come too late after fuel subsidy removal.

Atiku say di gornment fail to cushion di high cost of living, adding say only about 120,000 vehicles don convert to CNG in more than three years.

E say di figure na less than one per cent of about 14 million vehicles for Nigerian roads, and e describe am as evidence of policy failure.

Atiku say Nigerians don suffer enough from di gornment economic policies, telling Tinubu to prepare handover because ADC dey come to make life affordable again.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds