Lagos

Falana Demand Police Arrest As Tear Gas Scatter Pentioners

todaySeptember 1, 2026 4

Background
share close

By: Mariam Ajayi

Human rights lawyer, Femi Falana, call for di arrest of police officers wey  use tear gas scatter pensioners wey protest for Alausa, Lagos.

Di pensioners gather for Lagos State Gorment Secretariat and House of Assembly complex dey demand dia outstanding pension adjustments and wage awards before police scatter di protest.

Di retirees say di Lagos State Gorment never pay dem pension increases, consequential adjustments and wage awards despite di long-running dispute.

Di pensioners are expected to meet Gofnor Babajide Sanwo-Olu later dis week to present dia demands directly and seek solution to di unpaid benefits.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds