OBODO NAIJA

Nine Kpai for Oyo as Security Rescue Pipo Wey Kidnappers Carry

todaySeptember 4, 2026 4

Background
share close

By: Mariam Ajayi

Nine pipo, with four civilians and five security personnel, don die for operation to rescue kidnapping victims for Oyo State.

DSS Director-General, Tosin Ajayi, tuk say security operatives begin shap-shap chase after dem collect confam information about di kidnap.

E say one vigilante member and one police die for di first chase, as more pipo die when security forces later enter di kidnappers hideout.

Ajayi warn say fake videos and misinformation dey spread about di operation, as e call on media houses to properly fact-check and report only verified information.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds