Wi Federal Gornment look world bank eye ball to eye ball, say na nonsense dem dey do for di world bank, say which one be say Nigeria go pay 7.7 trillion naira just to pay interest for di money wey be say dem dey owe.
World Bank bin share recent report say Nigeria don spend about 124 percent of gornment money untop servicing gbese.
However, Finance Minister, Taiwo Oyedele, quickly drop statement ontop X on Sunday, to clear dis mata, say na fake news di world bank pipo dey share and dat di number nor correct.
In fact di Minster say, nobody suppose shakibalabala as di country economy don dey get more revenue.