Politics

Ladi Adebutu Become Gbademu of Owu Kingdom

todaySeptember 8, 2026 3

Background
share close

By: Ayobami Dada

Ogun PDP gofnorship candidate, Ladi Adebutu, don become Gbademu of Owu Kingdom, as e promise say e go use the traditional title push development for Owu, Egba and Ogun State.

Dem install Adebutu on Tuesday for Olowu palace for Abeokuta, with traditional rulers, politicians, family members and other big people present for di ceremony.

Adebutu thank Olowu of Owu Kingdom, Oba Saka Matemilola, say the honour no be ordinary title but call to serve and help develop the people.

The Olowu also charge Adebutu and hin wife, wey dem install as Yeye Gbademu, to work hard for the development of Owu Kingdom and Ogun State.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds