By: Mariam Ajayi
Election don reach everybody mind dey shakebalabala, nor be small prayer wey di All Progressives Progress  Congress fire yesterday Onikan stadium for Lagos, say any opposition wey Say Bola Tinubu and Kadri Obafemi Hamzat nor go win di 2027 election, say make dem comot body joor.
Senior mehn Pastors, Imams, and traditional worshippers naim put body for di mata.
Gofnor Babajide Sanwo-Olu, party chairmo Cornelius Ojelabi, plus representatives of di Oba of Lagos all storm di stadium alongside crowd from 20 LGAs and 37 LCDAs to seek spiritual power for di upcoming 2027 general elections.
At a point Sanwo-Olu carry mic begin clear supporters, prayer dey work magic, say infact God don hear dia prayers.