By:Â Damilola Adekunle
Education Minister, Dr Tunji Alausa, don hail NYSC as dem use technology fight fraud and make registration and deployment of corp members sharp.
Alausa tok dis on Wednesday for Abuja when NYSC Director-General, Brigadier General Olakunle Nafiu,visit am for office, tok say di scheme don record serious transformation since e embrace digital technology.
Di minister tok say although some pipo first resist di move, di Digital change don improve di registration process and make NYSC operations more easy.
NYSC DG, Brigadier General Nafiu, tok say dem don strengthen security features on corps member call-up and posting letters to stop fraudsters to dey copy fake documents, and employers fit now verify di letters easily.