OBODO NAIJA

Federal Gornment Release Allowance For Lecturers

todaySeptember 9, 2026 6

Background
share close

By: Mariam Ajayi

Federal Gornment don release  CATA for lecturers across federal universities, polytechnics and colleges of education, covering January to August 2026.

Education Minister, Dr Tunji Alausa, announce dis on Wednesday for Abuja after e inaugurate di Ministerial Committee on Accreditation, saying di payment follow di 2025 agreement between FG and ASUU.

Di allowance dey help academic workers buy tools and materials wey dem need for teaching, research and other academic work.

Alausa say di full eight-month payment don reach all federal universities, polytechnics and colleges of education, as government fulfil di agreement with academic workers.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds