By: Ayobami Dada
Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don declare wetin e call “small state of emergency” for waste management across Lagos.
Sanwo-Olu declare dis one as e dey inspect Olusosun dumpsite for Ojota, where Deputy Govo, Dr Obafemi Hamzat, and Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, follow am go.
Di inspection na to find out di problem wey dey affect work for di dumpsite and hin kon put immediate, medium and long-term measures wey go hellep solve di waste management crisis for di state.
Di Govo tok say di action dey very necessary to bring back effective waste collection and disposal across Lagos.