Entertainment

Carter Efe Vow Say E Go Beat Speed Darlington For Ring

todaySeptember 11, 2026 16 2

Background
share close

Nigerian content creator Carter Efe don vow say e go beat entertainer Speed Darlington when dem enter ring on October 1, tok say na because Speed dey talk about Burna Boy anyhow.

Carter tok dis one for heated face-off with Speed ahead of dia celebrity boxing fight wey go hold for Federal Palace Hotel, Lagos.

For di face-off, Speed Darlington tell Carter say na beating e go use beat am, as both men dey yarn hot yarnings giv diasef.

Carter fire back, dey ask why Speed dey stay close to bouncer, kon tell am make e face am one-on-one without bouncer, say e wan show am say e still be 24-year-old boy wey no dey fear anybody.

Carter also claim say Speed no fit expose am because na im dey hold pipo secrets, say di main reason wey make am wan beat Speed na because Speed allegedly call Burna Boy gay, add say if nobody stop am now, e fit tok di same thing about Davido.

Carter say e no just wan win di fight, e wan beat Speed reach point wey e go disgrace am, as dia ‘Chaos in di Ring’ boxing fight go happen October 1.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

Similar posts

Entertainment

Mohbad Family Sti Dey Fight for DNA of Hin Pikin

Di family of late Nigerian singer, Ilerioluwa Aloba, wey everybody know as Mohbad, don demand make dem reveal di name of di US laboratory wey dem wan send di sample go for di DNA test to clear who be di real papa of hin pikin, Liam. Mohbad family still call […]

todayOctober 30, 2026 7


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds