By: Mariam Ajayi
National Drug Law Enforcement Agency, wan scarra plans for boys, say dem don gbab boys with loads collos, wey dem hide inside music speakers, loaves of bread.
NDLEA spokesman Femi Babafemi naim dey porporly dis mata on Sunday.
Say dia operatives catch two packages of Colos wey dem send from United Kingdom, plus another two parcels wey dem pack put inside big sound speakers for Lagos motor park.
For Murtala Muhammed International Airport for Ikeja, officers intercept one UK-bound cargo wey load 27 parcels of Colos weighing 32.20kg, coming, after dem arrest at least seven suspects connected to dis dirty business.