By: Mariam Ajayi
Vice Presido Kashim Shettima don reach New York to represent Presido Bola Tinubu and lead Naija delegation for di 81st United Nations General Assembly.
Shettima say Naija go follow dia national interest and support multilateralism as e dey meet world leaders for di UN meeting.
E also say Naija go push for reforms wey go make global institutions more fair, representative and responsive to today economic and population realities.