Former Senate Presido, Pius Anyim say Nigerians know say Presido Bola Tinubu dey on short leave, as e defend di Presio absence from di ongoing United Nations General Assembly for New York.
Anyim tok dis one on Monday, say Tinubu fit send Vice Presido, Kashim Shettima to represent Nigeria for di UN meeting.
E say UNGA no be only di main General Assembly, as e say UNGA no be only di main meeting, as plenty meetings between Nigeria and other countries go happun for di side, and di Vice Presido fit handle some of dem.
Anyim say Tinubu only need to dey there personally if e get important meetings wey require im presence, and e no see why pipu dey make big matter out of di President’s absence.