Sports

20 Super Eagles Players Don Reach Camp For AFCON Qualifiers

todaySeptember 22, 2026 2

Background
share close

Twenty Super Eagles players don reach camp for Ikot Ekpene ahead of dia 2027 AFCON qualifying matches against Madagascar and Guinea-Bissau.

Di team open camp on Monday for Four Points by Sheraton Hotel, Ikot Ekpene, with coach Éric Chelle, im assistants and other backroom staff among di first people wey arrive.

Captain Wilfred Ndidi, Samuel Chukwueze and goalkeeper Stanley Nwabali dey expected to join di team later today, while dem go hold dia first training for Godswill Akpabio International Stadium, Uyo, tonight.

Nigeria go host Madagascar on Friday before dem travel go Bissau to play Guinea-Bissau next Tuesday.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds