By: Mariam Ajayi
Super Eagles captain, Wilfred Ndidi, don give strong assurance say di team no go repeat di mistakes wey cost dem during di last World Cup qualifiers.
Ndidi say di Super Eagles dey fully focused and ready to start di 2027 AFCON qualifiers with strong performance against Madagascar tonight for Uyo.
E say di first game important well-well because good start go give di team di confidence and momentum to face di other matches.
Di Super Eagles go meet Madagascar for Godswill Akpabio International Stadium, Uyo, tonight for dia first AFCON qualifier.