By: Kofoworola Olayinka
Industry, Trade and Investment Minister Jumoke Oduwole say Naija get about 26 out of 60 critical minerals wey United States dey look for around di world.
Oduwole tuk dis during interview, say di recent US critical minerals agreement na MOU and e no legally bind both countries.
She say Naija no go export di minerals raw, as gofment dey work with US to develop local processing, battery manufacturing and other value chains.
Di minister assure Nigerians say gofment no dey give away di country minerals, but go negotiate to protect Naija interests and create jobs.