Sports

Ronaldo Comot From Portugal Camp, Return Madrid

todayOctober 1, 2026 10

Background
share close

Cristiano Ronaldo don return Madrid after e announce say e don comot from Portugal national team camp on Wednesday.

Football transfer expert, Fabrizio Romano, disclose dis one for im post on X, as Ronaldo land for Madrid around 2 a.m. local time after e officially withdraw from di Portugal squad.

Di Al-Nassr striker reportedly decide to leave di camp after e discuss with Pedro Proença, President of Portuguese Football Federation, meaning say e no go play Portugal upcoming matches against Denmark and Norway for UEFA Nations League.

Di 41-year-old player feature for Portugal match against Wales, where dem rule out one of im goals, but e no play for dia recent victory over Norway, as e remain unused substitute.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds