OBODO NAIJA

World Bank Share Fake Report Giv FG – Minister Tok

todayOctober 19, 2026 5

Background
share close

Wi  Federal Gornment look world bank eye ball to eye ball, say na nonsense dem dey do for di world bank, say which one be say Nigeria go pay 7.7 trillion naira just to pay interest for di money wey be say dem dey owe.

World Bank bin share recent report say Nigeria don spend about 124 percent of gornment money untop servicing gbese.

However, Finance Minister, Taiwo Oyedele, quickly drop statement ontop X on Sunday, to clear dis mata, say na fake news di world bank pipo dey share and dat di number nor correct.

In fact di Minster say, nobody suppose shakibalabala as di country economy don dey get more revenue.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds