Lagos State govo, Babajide Sanwo-Olu, don appoint Dr Hassan Sanuth as new Managing Director of LAWMA, as reports say e don tell di former oga, Dr Muyiwa Gbadegesin, make e comot from seat because of di dirty wey gather for different parts of Lagos.
Di matter follow complains about plenty dirty wey dey block road, residential areas and gutters and canals, even after gornment don give order to clear dem, before di new appointment, Sanuth na Director of Sanitation Services for Lagos State Ministry of di Environment and Water Resources.
But as of Tuesday, October 20, gornment never officially konfamate di resignation request or Sanuth appointment.