Entertainment

Mohbad Family Sti Dey Fight for DNA of Hin Pikin

todayOctober 30, 2026 5

Background
share close

Di family of late Nigerian singer, Ilerioluwa Aloba, wey everybody know as Mohbad, don demand make dem reveal di name of di US laboratory wey dem wan send di sample go for di DNA test to clear who be di real papa of hin pikin, Liam.

Mohbad family still call for di postponement of di test wey dem schedule to hapun on Saturday, October 31, for Mainland General Hospital, Yaba.

Inside statement wey di head of di family, Samuel Aloba, sign on Thursday, di family explain say dem dey fear say wuruwuru go fit hapun on how dem wan take do di tissue-based test since dem wan collect samples for Lagos send go abroad.

Dem con say, dem need proper clarification on whether di Lagos State DNA and Forensic Centre, wey court order mention on May 5, 2026, go do di main test or dem go just collect di sample push am go America.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds