OBODO NAIJA

Tinubu Say E Feel Fulfilled After Umrah

todayOctober 30, 2026 5

Background
share close

Oga Presido Bola Ahmed Tinubu tok say e feel good and fulfilled after im perform Umrah for Makkah, Saudi Arabia.

E make dis statement today October 30th as e dey follow tori pipo tok for im visit to di holy city for di coming of di 2027 general election.

Senior men dem like APC Presidential Campaign Council DG, Senator Abdulaziz Abubakar Yari, some Govo dem and oda Gornment big men join am for di lesser Hajj.

Tinubu say di visit mean plenty to am and na chance to pray for Nigeria and all Nigerians.

E pray make Allah give leaders di wisdom and power to serve Nigeria well.

For im words, na God alone be baba and na im get power to determine human destiny.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds